Friday 25 July 2014

Conversation Between Jonathan and Sanusi in Aso-rock


Sanusi: Thunder fire you, weak guy, I no dey fear you o (Stares Jonathan Down).

Jonathan: Haha see this guy, na God save you o. Me and my minions ready yeye you. I say make I tell Ngozi and Deziani to cut you your share, you dey form whistle blower and Mr integrity.

Sanusi: Well no wahala, me I be Emir till i die. You? Your post get expiry date.

Jonathan: Guy pack well abeg, I know say i useless but I no ready to leave Aso-rock. The Shayo and air-con for here make sense die and na our turn to chop. See, I no send anybody, I no ready comot for Aso-rock, God punish poverty and all my haters.

Sultan: Ok guys, let't have dinner, I'm hungry my eyes dey turn me. 

No comments:

Post a Comment